Pipo for Sokoto don provoke enter forest to go confront bandits by diasef and rescue victims

Thousands of pipo from Gobir wey dey Sokoto state don provoke enter forest, say dem wan go by diasef confrontation bandits wey dey terrorize dem since for dia community. D pipo say since security officials nor fit protect dem, dem don take matas into dia hand to enter bush by diasef, and dem dey sure say dem go must rescue about 150 victims wey dese bandits carry comot. But police don tori say dem nor get any informate about 150 pipo wey dem napkin comot from Gobir Emirates for Sokoto.…

Abike Dabiri wey bi NIDCOM oga don release d face of di woman wey say she go kpai 9jas for Canada

Di chairman of Nigeria in Diaspora Commission NIDCOM, Abike Dabiri-Erewa, don release di foto of di woman wey dey rake up and down for social media say she go kpai some Nigerians wey dey stay Canada. Dem tori say di woman wey her name bi Amaka Patience Sunnberger and oda pipo dey get some discussion for TikTok space when she start to vibrate say oda tribes don too sidon for Igbo pipo head, and time don reach to kpai pipo from dis tribe, according to her vibration for TikTok, she…

Dem don jail four 9jas for UK wey dey forge marriage documents

Four 9jas don land for jail after dem forge more dan 2,000 marriage certificate take dey help oda japaris to stay UK illegally. According as di UK home office take tori am, dem say dese 4 9jas wey dia names na Abraham Alade Olarotimi Onifade, 41, Abayomi Aderinsoye Shodipo, 38, Nosimot Mojisola Gbadamosi, 31, and Adekunle Kabir, 54, dey among pipo wey dey commit crime of EU settlement scheme for oda Nigerians, and base on dis, dem com conviction dem for Woolwich Crown Court for London on Tuesday, August 27…

Appeal court don tori say Asue Ighodalo nai bi di ogbonge original PDP gwornor candidate

Appeal court wey sidon for Abuja don tori say na Aue Ighodalo nai bi di confam candidate for PDP for di election wey dem wan hold on September 21st for Edo state. According to di three-member panel of judges wey sidon for di mata, dem com first troway di former judgement wey bi nullify Asue candidacy before di three member of justice com pass dis new judgement. As Appeal court dey troway di mata, dem com tori say di person wey carry di mata com court nor bi aspirant, and…

171 Nigerians don return from Libya

National Emergency Management Agency (NEMA) don tori say dem don repatriate 171 Nigerians from Libya. Dem tori say dem receive dis our brothers and sisters for di Murtala Mohammed International Airport for Ikeja Lagos around in di evening, and among dem ma both grown men, women and children. Dem com tok say dem nor record any medical case with the returnee. According to di tori, dem say many Agencies com tanda for ground to give support to dis our brothers and sisters wey just return, and on top of di…

Ohovbe community for Benin city go start to enjoy 24hrs light

Edo state gworment don go commission 1-megawatt solar panel tins for di people of ohovbe wey dey Ikpoba Okha Local gworment area. Na Eng Godwins Omobayor wey bi di deputy gwornor nai commission dis project for di community. Tori kontiniu say di solar project supposed fit give about 2000 houses 24hrs light, dis na according to as di commissioner for mining and energy, Dr. Ojiefoh Enahoro take tori am during di event, him com further tok say dis solar mata wey go give 24hrs light to di community so, dey…

Police don tori say one man wey bi dey do 19 days fasting don kpai

Nigeria police don com tori say one 58 years old man for Lagos state wey bi dey do 19 days fasting don kpai. Dem tori say dis mata so happen on Monday for Alagbado area, and according to police, di man younger brother confirm say di man bi dey do 19 days dry fasting and na in di midst of di fasting nai him com kpai, so derefore dem nor suspect any kurukere doings except say dem go let di family prepare for di burial as dem ask.

Appeal court don direct former gwornor Yahaya Bello to report himself

Appeal court wey sidon gidigba for Abuja don give order to Yahaya Bello wey bi former gwornor of Kogi state to report himself with immediate alacrity for prosecution. No forget say di former gwornor bi pianteh since dat time wey EFCC, di commission wey dey prosecution any gworment official wey dem fit say e choplate di money dem supposed take work for dia state bi go raid am for e Abuja house, sake of say him get case to answer. Tori say since dat time after di raid nai dem…

Appeal court don tori say Philip Shaibu remains di deputy gwornor.

Appeal court for Abuja don tori say Philip Shaibu still remain di deputy gwornor of Edo state, dem tori say di first judgement wey Justice James Omotosho of federal high court first tok still remain, and base on dat them com dismiss di appeal wey Edo state house of Assembly file. Di court com tori further say dem still maintain say di way dem take impeach Philip Shaibu show say dem violate di constitution. Dem com later give directive say make dem pay Philip Shaibu e salary starting from April…