Di spokeman to presido Ajuri Ngelale, don tori for X wey be formal twitter say presido Tinubu go address Nigerians ontop di end bad gwornance protest wey dey shele since August 1st 2024 for nearly all di states for Nigeria. According to di way Ajuri Ngelale take tori am, im say di presido address go happen on Sunday wey be August 4th 2024 for around 7am and make all di media house tune in.
Category: We DI People
Communication commission don give order to tele company to reactivate all di blocked sim card
Nigerian Communications Commission (NCC) don giv order make dem reactivate all di sim card wey telephone company be block sake of say dem neva link dem to di national identification numbers wey be NIN. Na di NCC director of media and public affairs Reuben Muoka nai tori dis one today for im press release. According to di tori, MTN don already start to dey activate di lines wey dem be block because say some consumers be nor link am with their national identification number. Before then, some consumers bi don…
Presido Tinubu don give support to Dangote for di crude mata
Tori tok today Monday July 29th say presido Tinubu don stretch hand of support giv Dangote on top di crude oil mata wey bi dey get K-leg and bi wan turn oga Dangote to one motivational speaker since when di oda oga com out com tok say di Dangote refinery petrol bin dey one kai. Dem tori say di Federal executive council come support di idea wey presido bring comout to sell crude oil for naira give Dangote refinery and oda new refinery for di kontry. Tori kontiniu say, di…
Some Area for Edo and Delta state nor go see light for two weeks according to TCN
Di Transmission Company of Nigeria (TCN) don tori say light nor go dey for dia Amukpe substation for two weeks. Dem tori say di outage na to help contractors get environment wey dey safe as dem wan put two 132KV transmission tower for Amukpe substation. And becos of dis development, some communities for Edo and Delta state go face blackout for two weeks, becos say power supply nor go too much to Benin DisCo from Adeje industrial, woodland, Mosogar, Sapele and Abraka feeders during dis period wey contractors wan take…
FG don declare today May 01 as holiday
Happy workers day as federal gworment don declare today May 01 2024 as holiday, so dat workers go see chance take celebrate. Na di minister of interior Dr. Olubunmi Tunji-Ojo, nai tori dis mata wey di Permanent Secretary, Dr. Aishetu Gogo Ndayako sign on Tuesday for Abuja.
Nigerians say na social media, laziness plus hunger nai make Jamb result poor well well
Nigerians don tori say na too much social media, laziness plus di hungry wey dey land nai make student wey sidon write Jamb dis year nor pass well. According to di response to one post wey Tribune online do, Nigerians com tori say, e dey very bad say out of 1,989,668 students wey Jamb say register and sidon for di exam, a whole 1,402,470 com get score wey dey below 200. Some pipo com still tori say, students dese days nor wan study, say majority of dem na just to…
Osun state gwornor Adeleke say im neva borrow any moni since im resume office
Gwornor of Osun state, Ademola Adeleke, don tori say im never borrow any moni since when im become gwornor of di state. Di gwornor tori dis one wey im dey give di pipo report of e stewardship for di second edition of dia ipade imole forum. Gwornor Adeleke com tok say di rison wey im never boro any kobo bi say, di plan dey among di plan and di pledge wey im make, say im nor go boro moni, but im go use di resources wey dey available take work…
University of Benin don suspend student union gworment becos of di attack wey happen to LP gwornorship candidate
University of Benin, Edo state don suspend di Student Union Gworment SUG till further notice, becos of di attack mata wey be happen to Labour Party gwornorship candidate wey bi di person of Olumide Akpata. According to di Registrar Ademola Bobola, im tok say di university management approved dis suspension wey don already start since Monday 29 2024. Im com add say dem don set up caretaker committee in di main time wey go dey conduct student mata, and dis committee get representatives from faculties, schools and institute.
Ondo state gworment don tori say di N5billion for day care renovation na error from printer
Ondo State government don com clarify di mata wey tori pipo bi carry about how di state for dia budget wan take use N5billion take renovate one day care, dem tok say na printer nai cos di error. Na Sahara reporter be report di mata of how di state bi wan take use di N5billion take renovate day care, dem com salute Sahara reporter say na dia eagle nai detect di error. You fit read di complete story for Ondo Government Says N5Billion Budgeted To Renovate Daycare Centre Was ‘An…
Federal gworment don approve increase of salary for civil servants
Remember say di Nigeria Labour congress NLC, don dey waka upandan since for dis salary increase for workers, base on di inflation wey almost everybodi dey face for di nation. We go say base on dis, Tinubu gworment don finally approve almost 25-35% increment for civil servants, and health sector dey among dose wey benefit from dis increment through di Consolidated Medical Salary Structure (CONMESS) and Consolidated Health Sector Salary Structure (CONHESS), as tori tok say some other sectors bi don first get dia increment. Na di Head of Press,…