One of our brother don share one video from gossip mill after vigilante group for Benin city Edo state tell another of our brother say make him come down from inside commercial bus say them wan check e bag.
Na there di boy start to dey para and begin ask make di vigilante people show their ID card to prove say dem nor bi fake vigilante and fake gworment worker, and for di video we nor see say di vigilante people dey make any attempt to show our brother their ID card to identify theirselves, as you dey look am for di video below so
Di question wedipeople dey ask be say, Vigilante people get the right to search any body bag? wetin be di reason dem dey stand for road and ask somebodi to come down from a commercial vehicle say dem wan search e bag.
We want make di authority wey dey in charge of dis vigilante group for Benin respond, so dat we di people go know where di activities of dis vigilante group for start and where their activities for end.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.