Di Joint Admission and Matriculation Board (JAMB) don tori say, dem don arrest one man and im pikin becos say di papa go write JAMB-UTME exam for im pikin, wey oyibo dey call exam malpractice.
Jamb nor mention di name of di papa and im pikin, but dem tori say di papa commit di offence when di Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) dey go on.
Na Prof. Ishaq Oloyede, wey bi di Jamb registrar, nai tori dis one when im dey inspect di UTME centres for Kaduna on Wednesday. Im com tok say dem catch di papa as im dey try to write di exam for im pikin, and right now police don arrest both papa and pikin.
Prof. Ishaq com further tori say di mata nor happen for Kaduna, and e nor go mention di state wey di papa and pikin for commit di offence, but com warn say, technology don make am dey easy to catch anybody wey plan to cheat for any of di exams, say make people stop to dey cheat because e nor dey pay and dem go catch dem, like dis papa and pikin wey go dey look each other for inside cell.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
That’s what you get when you fail to do the right thing for our children, I will advise the jamb body to use this man and his son as an example to the public.