Di Edo state commissioner for communication and orientation, Chris Nehikhare, don encourage we di people for di state to go about their lawful businesses and activities without fear, and ask them to call di state emergency numbers wey be 112 or 739 to report all suspicious persons or activities within their environment. Dis assurance dey com in d midst of d mata wey happen regarding di state PDP chairman Tony Aziegbemi, tori say d people wey whisk am comot from im car on friday night and carry am go unknown…
Year: 2024
Nigerian passport don rank 98th for di world
According to one tori from Henley index report, Nigerian passport don rank 98th for di world, with free access to only 45 destinations for di world. And dis na di 45 destinations Nigerians fit travel to with their passport. 1.Barbados2. Benin3. Burkina Faso4. Burundi5. Cambodia6. Cameroon7. Cape Verde Islands8. Chad9. Comoro Islands10. Cook Islands11. Cote d’Ivoire12. Djibouti13. Dominican Republic14. Fiji15. Ghana16. Guinea17. Guinea-Bissau18. Haiti19. Iran20. Kenya21. Kiribati22. Lebanon23. Liberia24. Madagascar25. Maldives26. Mali27. Mauritiana28. Mauritius29. Micronesia30. Montserrat31. Mozambique32. Niger33. Niue34. Palau Islands35. Rwanda36. Samoa37. Senegal38. Sierra Leone39. Somalia40. St. Kitts and…
Think Twice
Sometimes, if we go just use small time take think twice about any situation wey happen, we go discover say we for nor take di action wey we take regarding dat situation. I don discover say, di small time wey we dey use take think twice before we take any action, go save us from so many trouble and regret. So, as you dey start your day, incase any mata or situation happen, just remember say you read for somewhere say, no mata wetin happen, make you use small time…
Who Be Patriotic Citizen?
According to oxford dictionary, patriotism means dedication, devotion and better support for your country. Den com tok say patriotic citizen nah di feeling of devotion and attachment wey people or persons get for their country. My question now be say, you be patriotic citizen? and wetin patriotic citizen mean to you and how patriotic citizen take dey behave? If we quote Allen Onyema, d chairman of Air Peace, where him for tok about patriotism during one interview with vanguard, him come tori say, “As citizen of Nigeria, all of us…
Rotary don advise Nigeria to shine eye well on top polio mata
Di presido for Rotary international, Gordon R Mclnally, don advise say make Nigeria make sure say dem shine eye on top polio mata, to make sure say e nor come back again for di country. D presido of rotary international come tori dis one with journalist for Abuja after him carry some members of d organization to visit presido Tinubu. Gordon wey be rotary president com tori say one of di reason wey make dem com see presido Tinubu na to tell am say thank you for how Nigeria don…
E be like say d suffer go double as inflation don reach 31.7%
Inflation for Nigerian don reach 31.7% according to d tori wey National Bureau of Statistics (NBS) carry com out yesterday, and d nation never see dis kind inflation wey high well well so since 28 years. According to di mata, dis inflation com mean say Nigeria still dey within di top 10 countries for Africa wey get high inflation rate. And food inflation com remain d highest.
This japa mata
One man don talk say e nor understand d sense of how person go struggle gather say something like N20 million take japa to another man’s land, only for d person to go start to hussle from scratch, d man say him wan know which kind brain dese people get o. Na instablog9ja nai share dis tori for e X handle. Abeg help di man understand how people dey manage struggle for millions to take japa and reach dere go start from scratch. God bless Nigeria
D solutions dey always dey inside di problem
As you dey start your day, I wan make you know say most of di time, if you sidon look well, you go discover say d solution wey you dey look for dey inside di problem. So no mata how bad di problem be, just take time take sidon, and den figure out d solution small small from dere. Have a beautiful day.
NANS don ask for probe of d mismanagement of Ajaokuta steel
D National association of Nigerian student, NANS, don tok say make dem probe d way people take mismanaged money for Ajaokuta steel company and d national iron ore company wey dey kogi state. D association through deir president Lucky Emenofe com accused some official for d past government under Buhari, say dem mismanaged a whole $496 million as e concern d Ajaokuta steel. Lucky Emenofe come tori for im statement say, dem thank presido of d country for d way e dey try to make sure say d company work,…
Bishop Oyedepo don open care centers around d country to help people in need
Bishop David Oyedepo of living faith church wey we know as winners chapel don advise say make christians reach out to d people wey dey in need around dem to help with d hardship wey dey happen for we country right now. Bishop com tori further say, winners chapel don open plenty kingdom care centers to help d needy, and dis help go be through d winners satellite fellowship wey dey across Nigeria, as im com further tori say nor be weakness to ask for help when u need am.…