Nigeria police don arrest one trader for Abuja wey dey repackage local rice as foreign rice to make more money

Police don arrest one 39-year-old trader, wey dem identify as Nonso Nwobodo for Abuja wey be d federal capital territory. Dem catch am as him dey repackage local rice put inside foreign rice bags to make more money. According to Sahara reporter, d matter happen on Saturday around 4:15 pm for Plot 740 centenary credentials Durumi area of FCT Abuja. One government person wey tori Sahara reporters talk say Nonso dey try pack local rice put inside foreign rice bags to deceive people say na foreign rice, and dem come…

Nigerya Air Force NAF don destroy some illegal refinery for Rivers

Nigerian Air Force (NAF) tori say dem air component of operation Delta safe don destroy four illegal oil refining sites for Krakama and Temakiri for Degema Local Government Area of Rivers State. NAF director of public relations and information, Air Vice Marshal Edward Gabkwet, wey tori dis one, say d operation dey continue to reduce d activities of people wey dey thief crude oil and destroy oil pipelines. Gabkwet, for one statement, tori say both places dey just 50 km Southwest of Port Harcourt, wey be d capital of Rivers…

Some passengers behavior dey make aviation sector dey loss almost N15billion yearly

Vincent Onyema wey be chairman of Air peace airline don tori say na d way wey some passengers take dey behave nai make airline and aviation sector dey loss almost N15billion yearly. E tory dis one for one interview wey im sidon with Arise TV tori few days ago, e come tori say apart from weather and other protocool, say d next thing wey dey cause flight delays na d way passengers for Nigeria take dey behave sake of say dem nor understand d culture of rescheduling after cancellation. Oga…

John Okafor wey we know as Mr Ibu don die

Mr Ibu as we popularly know am, don die on saturday March 2nd 2024 inside one hospital for Lagos. Mr Ibu be dey battle some sickness before e come finally die. We go miss am for all d laff wey im put for people face during e time as nollywood actor. We ask God Almighty to grant im eternal rest and grant d family d patience to bear d loss.

Some people don go Nema warehouse for Abuja and dem don loot foodstuffs and many other things comot

Some people wey dey live for Federal Capital Territory don go raid and scatter warehouse wey belong to National Emergency Management Agency of Nigeria (NEMA). We hear say na d warehouse we dey for Karimo, Phase 3 area of FCT, Abuja dem go raid on sunday morning and d people come carry foodstuffs and oda things comot for there. Police people from Nigeria Police Force for Abuja don go d area to chase away d people wey dey loot and secure d building. According to d spokeperson for FCT police…

Our corner ear hear say Abia state go soon launch light rail construction project

Governor Alex Otti of Abia state don tori say im don dey discuss with some Chinese company on how dem go take bring light rail construction project wey go pass d whole state of Abia. E tori dis mata on Thursday for politics today as im dey trow more yannings give Seun Okinbaloye of channels Tv regarding d whole mata for geometric power wey dem just commission. Him come continiu to tori Seun say na one of e promises be dat and even if say e no go easy e…

Ballot development

Remember say every election, ballot box and ballot paper go reach all d villages for we country even doe say development nor dey reach dere. Make we nor stop to dey ask everybody wey we vote for to give we d people ballot development d way dem dey carry ballot box and paper come. Na our right as we d people to ask for accountability from d people wey we vote for. God bless Nigeria.

Health matas

Medical people say for good eyes make you eat carrot. And for good better shining skin make you eat or dey drink lemon water. For good kidney we d people continiu to drink plenty water For cough eat pineapple for stress eat banana Above all, take care of your mental health, nor too dey think, everything go dey alright. When dere is life dere is hope. if you fit pray, Pray.

Dem say one person don kpai and others dey hospital after dem chop cassava flour wey no good for ogbomosho

One person don kpeme and five others dey fight for their lives for ogbomosho oyo state afta dem chop cassava flour wey tori say e be like say dem cook am with cassava flour wey dem fit say na yam flour and d cassava flour no come good. Tory say d mata happun for Wednesday night, Feb. 28, for Temidire Atoyebi area along Ajaawa Road for Ogbomoso. Dem say d family wey dey involve na one grandmama wey dem identify as Mrs. Victoria Paul Adewole, and she get four children,…