Police don arrest one 39-year-old trader, wey dem identify as Nonso Nwobodo for Abuja wey be d federal capital territory. Dem catch am as him dey repackage local rice put inside foreign rice bags to make more money.
According to Sahara reporter, d matter happen on Saturday around 4:15 pm for Plot 740 centenary credentials Durumi area of FCT Abuja.
One government person wey tori Sahara reporters talk say Nonso dey try pack local rice put inside foreign rice bags to deceive people say na foreign rice, and dem come recover 160 bags of rice wey different sizes range from 5kg to 50kg wey dem don rebag to look like foreign rice.
D person talk say, “Nonso Nwobodo dey repack local rice put inside different designed foreign rice bags dey try sell am as foreign rice.”
The person come tory say dem arrest am with 160 bags of rice with different sizes ranging from 5kg to 50kg wey dem don rebag to look like foreign rice say dem also recover 53 empty bags of local rice wey dem don rebag to foreign bags and Police don already seize d rice.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.