NEMA don tori say no be dem get d warehouse for FCT wey people talk say dem loot on Sunday. Dem talk say d warehouse wey hoodlums enter no be dem own at all.
D statement wey dem release for their X handle tori say; “NEMA don hear wetin people dey yan for media on Sunday about how some hoodlums go loot warehouse for Abuja wey belong to dem.
“We wan make una sabi say the warehouse wey dem loot no be our own at all. But we dey sorry for the people wey warehouse belong to.
“To make sure say nothing spoil for NEMA office and warehouse, the Director General Mustapha Habib Ahmed don tell di Zonal Directors and Heads of Operations to make security strong for all d NEMA offices and warehouses wey dey all over Nigeria.”
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.