As e come bi now, we nor need anybody to come from space to tell us say we need to shine our eye put for education mata for our children, especially for di almost 20 million wey nor dey go school wey di borku number dey north side.
While na every citizen right to demand wetin dem want from dia gworment, and com decide to enter street to go tok as e dey do dem for bodi, we don see wetin fit happen wen children nor dey go school or get access to education.
Base on dis mata, I dey beg all our gworment official to take di children education mata serious, so dat we go carry all dis children comot from area and enroll dem for school, if na to declare education emergency for dis area wey children wey nor dey go school high well well, and come make sure say any papa and mama wey dia children nor dey school wey suppose dey school, gworment go hold dat mama papa or any guardian responsible on top why di pikin nor dey classroom dey learn.
This na education emergency call to action, and thank God say nor bi rocket science again for dis our millennium for gworment to see say all e pipo get quality education starting from di basics, becos according to Nelson Mandela wey bi Africa Hero, him tori say “Education na di most powerful weapon wey you go use take change di world”
Make all gworment especially for Africa and we kontri folo di advice of our hero Nelson Mandela and prepare dia citizen from scratch to use education take change di world., na one of di reason wey make citizens go polls to go elect dia officials, so dat dem go provide di pipo with beta education.

Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.