Nigerian Air Force (NAF) tori say dem air component of operation Delta safe don destroy four illegal oil refining sites for Krakama and Temakiri for Degema Local Government Area of Rivers State.
NAF director of public relations and information, Air Vice Marshal Edward Gabkwet, wey tori dis one, say d operation dey continue to reduce d activities of people wey dey thief crude oil and destroy oil pipelines.
Gabkwet, for one statement, tori say both places dey just 50 km Southwest of Port Harcourt, wey be d capital of Rivers State.
E still tori say for both Krakama and Temakiri, dem see active illegal oil refining sites and dem see Cotonou Boats wey dey nearby wey fit wan siphon crude oil illegally from the sites. E come tori say dem kon strike d two illegal sites and d boats wey come make dem catch fire and destroy.
E say dem also search Abisse and Omoma, but dem only see abandoned illegal refining sites.
E say efforts to stop d activities of oil thieves for Niger Delta by NAF and other security agencies still dey go on and dem go continue until dem achieve d success dem want.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.