Presido Tinubu don warn say any official wey no get reason make e nor enta UN Assembly

Presido Tinubu don issue beta warning give gworment officials say make any of dem wey nor get any business to do for di United Nations General Assembly meetings nor step dia foot enter America where di meeting go for shele for September. Na chief of staff, Femi Gbajabiamila, nai tori dis presido warning give heads of government agencies for di one-day retreat wey dem organize for state house on Saturday. Him com further tori say di reason for dis presido warning na di step wey di renewed hope administration dey…

NAFDAC don close one kurukere alcohol factory wey dey operate for Lagos Island yonda

Di National Agency for Food and Drug Administration Control wey be NAFDAC, don tori say dem don catch some people wey dem believe say dem dey produce alcohol illegally for rooms wey dem turn to factory inside area for Oke-Arin market. Dem tori further say after di catching wey dem catch catch dem, NAFDAC come seize goods wey reach almost N200 million, na for dere dem come beg everybody to shine dia eyes well well especially wen dem dey want buy anything alcohol or beverages. Na three suspects dem arrest…

Innoson motors chairman don tori say CNG buses go soon brekete borku for everywhere for we kontri

courtesy Innoson vehicle manufacturing.

Innocent Chukwuma wey be di founder and chairman of Innoson motors don tori say CNG buses go soon borku for we kontri, and dis go com help reduce price of transportation wey dey also contribute to serious hardship wey di pipo dey complain put since. Innocent tori dis one after he meet with presido Tinubu for Abuja on Thursday. Him tori say di CNG idea wey presido get na very good tin for di masses since Nigeria get plenty borku gas wey go power dis idea. Chukwuma com beg Nigerians…

Nigeria immigration don suspend one staff wey dey beg people money for airport

Di comptroller general of di Nigerian immigration service don tori say dem don suspend one of dia officer wey social media dey share upandan say him dey beg traveler money for one of di airports. Di comptroller Mrs. Kemi Nandap tori dis one on Thursday through Mr. Kenneth Udo wey be di immigration public relations officer. Di tori kontiniu say Mrs. Kemi don condemn dat bad habit wey di officer wey dem dey call Okpravero Ufuoma display before di traveller, she com tok say dat kind behavior nor show di…

Obasanjo don tori say AI fit help out of school children for Nigeria

Former presido Olusegun Obasanjo don tori say artificial intelligence (AI) fit become beta ogbonge tools wey go help shine light on top di many out of school children wey don almost turn to crisis for Nigeria. Na for di 50th anniversary of learning opportunities wey distance learning institute Unilag organize nai former presido for tori dis one. Obasanjo further tori say Nigeria get almost 20 million children out of school right now and artificial intelligence and open distant learning na some ways wey institutions fit take manage di situation.

Enugu gworment don approve N163bn make dem take construction 161 roads

Di secretary to di state gworment (SSG), Prof. Chidiebere Onyia, don tori yesterday to tori tori people for gworment house say, di state gworment don approve N183 billion make dem take construction more roads round di city, and nearly 20 of dis road go dey inside community wey oyibo dey call rural area, and dis go be for di three senatorial districts. Oga SSG also tori say dis dey happen becos of di plan wey gwornor Peter Mbah get to grow di state economy from $4.4 billion to $30 billion.…

NDDC don ask youth to register for di 6bn training scheme

Niger Delta Development Commission (NDDC) don tori youth wey dey Niger Delta say make dem take advantage of di special training wey di commission don set up wey go help dem acquire some kai ogbonge skills wey dem fit market. Na Mr. Chiedu Ebie, wey be di governing board chairman, nai tori dis mata when dem dey launch di youth internship scheme for Port Harcourt on Monday. According to di chairman, him further tori say di scheme go help youth wey go participate dey ready for employment. Dem say na…

22,120 students don benefit from di N2.5bn student loan wey dem just disburse

Di Nigerian Education Loan Fund (NELFund), don tori say dem don disburse N2.5bn to 12 schools across di country for di application wey dem receive from 22,120 students. Na Nasir Ayitogo wey be spokesperson for NELFUND nai tori dis mata for one of im statement on Friday for Abuja, im com tori further say dem carry out dis disbursement according to as every school calendar year take dey resume. Dis images na from Nelfund website- (nelf.gov.ng) Oga Nasir come tori further say, all di amount wey dem don give di…