Usman Mohammed don share pictures of wetin dey happen for Kaida primary healthcare centre for gwagwalada area council for Abuja, im come share how d hospital take decay for e X handle, Usman say bush don cover d hospital and doors nor even dey plus windows nor good. Usman no come forget to mention Senator Ireti Kingibe, say d senator don neglect d hospital. We call on our able senator to look into dis mata and give d people d ballot box development.
Month: March 2024
Inspector general of police don ban POS operators for police station for d whole country
D inspector general of police, Kayode Egbetokun, don ban operators of point of sale wey we know as POS and other electronic mobile money transaction devices comot from police station and police facilities round d country. Oga IGP tori dis mata on monday say d ban dey necessary at dis time becos of d wayo transaction of POS machine operators with some police officers for we country. ACP Olumuyiwa Adejobi wey be d police public relation officer come further tori d mata say d directive from IGP na to preserve…
Ukraine don donate 25,000 tons of grains give north east Naija
D United nations world food program (WFP) don thank d government of Ukraine for their kind donation of 25,000 tons of wheat wey go help give emergency food support to almost 1.3 million people wey dey affected for northeast Nigeria. Na Atinuke Akande-Alegbe wey be senior communications and public diplomacy officer of d British high commission for Abuja nai tori dis mata on Thursday. Dem talk say dis important contribution na part of Ukraine’s humanitarian grain from Ukraine initiative wey President Volodymyr Zelenskyy launch. Dem add say d arrival of…
Reps don ask private airline operator to give account of d covid-19 relief funds
D house of representatives public accounts committee don give private airline operators for Naija one-week deadline to explain how dem take use d N4bn wey federal government give dem to fight COVID-19 or make dem refund d money if dem no fit provide evidence on how dem take spend am. D committee wey Bamidele Salam, one member of d Peoples Democratic Party from Osun State wey be d chairman nai give d ultimatum on friday for d resumed investigative hearing on top d mata wey concern mismanagement of COVID-19 relief…
Senate don talk say dem go probe d N30tn loans
Nigeria senate don talk am say dem go start to question some central bank officials on how dem take give out and d spending wey surround d 30 trillion naira loan for ways and means wey federal government collect during former president Buhari. Na d chairman of d senate ad-hoc committee senator Isah Jibrin nai tori dis mata for one of e tori, e come tori say d probe go start this week. D senate tori last week say dem go probe how dem take spend d money because d…
President Tinubu don tell Qatari official to report any Nigerian official wey go ask for kpaje wey dem dey call bribe
President Tinubu don tell ogas for Qatari industry to report any Nigerian official wey go ask them for bribe before dem do business for we country. Na d special adviser to d president on media and publicity, Ajuri Ngelale nai tori dis one for one of e tori. President Tinubu come still assure d international business community say Nigeria dey very serious and ready to do business and him go make sure say e administration remove any bottle neck wey go tanda for d road of any legitimate business for Nigeria.
NEMA don talk say nor be dem get d warehouse wey tori say dem loot for Abuja
NEMA don tori say no be dem get d warehouse for FCT wey people talk say dem loot on Sunday. Dem talk say d warehouse wey hoodlums enter no be dem own at all. D statement wey dem release for their X handle tori say; “NEMA don hear wetin people dey yan for media on Sunday about how some hoodlums go loot warehouse for Abuja wey belong to dem. “We wan make una sabi say the warehouse wey dem loot no be our own at all. But we dey sorry…
Nigeria police don arrest one trader for Abuja wey dey repackage local rice as foreign rice to make more money
Police don arrest one 39-year-old trader, wey dem identify as Nonso Nwobodo for Abuja wey be d federal capital territory. Dem catch am as him dey repackage local rice put inside foreign rice bags to make more money. According to Sahara reporter, d matter happen on Saturday around 4:15 pm for Plot 740 centenary credentials Durumi area of FCT Abuja. One government person wey tori Sahara reporters talk say Nonso dey try pack local rice put inside foreign rice bags to deceive people say na foreign rice, and dem come…
Nigerya Air Force NAF don destroy some illegal refinery for Rivers
Nigerian Air Force (NAF) tori say dem air component of operation Delta safe don destroy four illegal oil refining sites for Krakama and Temakiri for Degema Local Government Area of Rivers State. NAF director of public relations and information, Air Vice Marshal Edward Gabkwet, wey tori dis one, say d operation dey continue to reduce d activities of people wey dey thief crude oil and destroy oil pipelines. Gabkwet, for one statement, tori say both places dey just 50 km Southwest of Port Harcourt, wey be d capital of Rivers…
Some passengers behavior dey make aviation sector dey loss almost N15billion yearly
Vincent Onyema wey be chairman of Air peace airline don tori say na d way wey some passengers take dey behave nai make airline and aviation sector dey loss almost N15billion yearly. E tory dis one for one interview wey im sidon with Arise TV tori few days ago, e come tori say apart from weather and other protocool, say d next thing wey dey cause flight delays na d way passengers for Nigeria take dey behave sake of say dem nor understand d culture of rescheduling after cancellation. Oga…