Di comptroller general of di Nigerian immigration service don tori say dem don suspend one of dia officer wey social media dey share upandan say him dey beg traveler money for one of di airports.
Di comptroller Mrs. Kemi Nandap tori dis one on Thursday through Mr. Kenneth Udo wey be di immigration public relations officer.
Di tori kontiniu say Mrs. Kemi don condemn dat bad habit wey di officer wey dem dey call Okpravero Ufuoma display before di traveller, she com tok say dat kind behavior nor show di professionalism wey dem know Nigeria immigration service for, and becos of di action wey Okpravero Ufuoma display dem don suspend him till wey dem go decide di discipline, and dis na on top di zero tolerance wey immigration get for any misconduct and corruption mata.
Dem further tori say plenty reforms dey go on like di electronic gates wey go make travelling mata dey very smooth for travelers.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.