Di National Agency for Food and Drug Administration Control wey be NAFDAC, don tori say dem don catch some people wey dem believe say dem dey produce alcohol illegally for rooms wey dem turn to factory inside area for Oke-Arin market. Dem tori further say after di catching wey dem catch catch dem, NAFDAC come seize goods wey reach almost N200 million, na for dere dem come beg everybody to shine dia eyes well well especially wen dem dey want buy anything alcohol or beverages. Na three suspects dem arrest…
Blog
Ajaokuta steel, 23 Russian engineers don land for dere to see how to make am work
E be like say wedipeople go soon start work for Ajaokuta steel as dem say 23 engineers from Russian wey be di original builders of di Ajaokuta steel company don land for Kogi state for inside di Ajaokuta steel gongon to start to conduct technical work. According to di tori dem say di team don dey start to check some kurukre plants wey nor dey work since to see how dem go fit take make am work.
Fuel scarcity, gworment don tori say dem go vex revoke oil marketers license
Nigerian gworment don tori say dem go revoke di licence of any marketer wey dem catch say dem dey hide fuel for some corner or dey sell am for black market give pipo wey dey use jerrican take buy. Gworment tori dis serious warning inside di fuel scarcity wey dey happen for di kontri dese days especially for some states for north yonda.
AAC party candidate don defeat PDP and APC candidate for Bauchi local councilor election
Bauchi state independent electoral commission don announce di winner of di councillorship election for Papa ward wey happen Saturday August 17th, 2024, for Darazo local gworment area. Di electoral body com tori say na di candidate of AAC Yunusa Muhammed be di winner of di election after him win with 1,156 votes to defeat other candidate from di ruling parties dem. Tori com further tok say nor be small people come out for Darazo local gworment area to make sure say dem vote for Yunusa Muhammed as councilor wey go…
We need to shine our eye put for children education for we kontri
As e come bi now, we nor need anybody to come from space to tell us say we need to shine our eye put for education mata for our children, especially for di almost 20 million wey nor dey go school wey di borku number dey north side. While na every citizen right to demand wetin dem want from dia gworment, and com decide to enter street to go tok as e dey do dem for bodi, we don see wetin fit happen wen children nor dey go school or…
Everytin nor go always stay di same
For dis life, e go always good to remind ourselves say everytin nor dey always stay di same or e nor go always bi di same. Sometimes you go laugh, sometimes you go cry, but while e somehow bi like say we nor dey fit control di tins wey dey make us laugh or cry sometimes, nature don come empower us to always fit control or manage di situation. while we get dis for mind, we go kontiniu to pray say na so so wetin go make us laugh nai…
Innoson motors chairman don tori say CNG buses go soon brekete borku for everywhere for we kontri
Innocent Chukwuma wey be di founder and chairman of Innoson motors don tori say CNG buses go soon borku for we kontri, and dis go com help reduce price of transportation wey dey also contribute to serious hardship wey di pipo dey complain put since. Innocent tori dis one after he meet with presido Tinubu for Abuja on Thursday. Him tori say di CNG idea wey presido get na very good tin for di masses since Nigeria get plenty borku gas wey go power dis idea. Chukwuma com beg Nigerians…
Nigeria immigration don suspend one staff wey dey beg people money for airport
Di comptroller general of di Nigerian immigration service don tori say dem don suspend one of dia officer wey social media dey share upandan say him dey beg traveler money for one of di airports. Di comptroller Mrs. Kemi Nandap tori dis one on Thursday through Mr. Kenneth Udo wey be di immigration public relations officer. Di tori kontiniu say Mrs. Kemi don condemn dat bad habit wey di officer wey dem dey call Okpravero Ufuoma display before di traveller, she com tok say dat kind behavior nor show di…
Obasanjo don tori say AI fit help out of school children for Nigeria
Former presido Olusegun Obasanjo don tori say artificial intelligence (AI) fit become beta ogbonge tools wey go help shine light on top di many out of school children wey don almost turn to crisis for Nigeria. Na for di 50th anniversary of learning opportunities wey distance learning institute Unilag organize nai former presido for tori dis one. Obasanjo further tori say Nigeria get almost 20 million children out of school right now and artificial intelligence and open distant learning na some ways wey institutions fit take manage di situation.
Anytin wey get begining get end
As you dey start your day, remember say, anytin for dis life wey get beginning go surely get end. And if you dey let dis principle guide you, you nor go wan kpai yourself over some kai kurukere mata wey nor go lead person go anywhere, you go wan treat odas di way you want make odas take treat you, you go automatically mature, sotey you go come realize say you nor dey in competition with anybody but only yourself, becos e go don come tanda for your mendulla oblongata…